COPYRIGHT

" "

Wednesday 5 December 2012

Naija Muse..(Pidginized)


Subsidy or Suddenly?




Yab Soja-man pieces

Aha!! u go rest in pieces

Spit for Presido eye inside Ikoyi maximum prison

U go realize say U don commit treason



Add sugar and milk powder
For inside Lekki Beach water
Maybe the alkaline taste go turn sweeter
Afterall, River Mara for Bible be be dey bitter.
But with small salt wey dey Prophet add, the thing begin taste sugar-sugar

Write 'Learner' as title for back of aeroplane 
Dem go feel say na riddle, No blame.
U fit from Lagos visit McCain for Seattle with small change
Unto say dem crest your name for American Hall of Fame

For tight security for Maya Angelou Memorial Poetry Extravaganza
Two Naija Celeb strongmen fit stand as Bouncers
9ice and Nabania Na All rounder
King Olulu & him Council of Elders, Chief organizers.


I dream see Beyoncee for Ajegunle to be precise
Bend down select, Kai! so waitii sef dey patronize
At least once
Sweet rich Naija we need to realize.

Pass through Canal to Canada
E no matter even if your name no be Martha
Mr. Faith go peruse Mr. Fate, carry you pass Nevada,
Ontario, Toronto, Atalanta, d journey go sweet pass Mirinda

So for we wey Still believe in 'Obodo Naija' 4real
Make we dey happii plus jolly
Do our thing as we sabi
Na freeworld, no be 'craze world', no cause to worry.

Forget Boko, just do your things lovingly and jejely
Whether na Subsidy, austerity or our girls wey dem abduct Suddenly
Baba God go arbitrate them definitely
'Cos Na only Him fit unlock plus release our Good wey dem lock, unfailingly.

Written by: Bankole Kolawole
Edited by: Bamgbade Bams Adetoyese

No comments:

Post a Comment